Topic: PIDGIN SPORTS: Emenike Dey Vex for Naija Coach- Keshi  (Read 2362 times)

0 Members and 1 Guest are viewing this topic.

PIDGIN SPORTS: Emenike Dey Vex for Naija Coach- Keshi
« on: March 17, 2013, 10:01:49 AM »


Ogbonge Naija Super Eagles star, Emmanuel Emenike don dey para for him coachi, Stephen Keshi and even de NFF pipu dem wey dey control futbol for Naija as de guyman yarn say dem no try for am at all since him don carry de injury wey him nack for de 2013 Nations cup for South Africa.

Na for de semi final game wey Naija take skatta Mali 4-1 na im de guyman take suffa de injury and him don dey vex now dat nobody from de NFF pipu bother to ask about how him dey feel.

Make unna no forget say na dat injury wey him carry no allow am to play de 2013 Nations cup final wey Naija take style flog Burkina Faso 1-0 for dem to carry de trophy.

The injury wey dey worry am (Emenike) no even allow de Super Eagles manija, Stephen Keshi to luk him face, as de 'Big Boss' no kuma invite am for de 2014 world cup kwalifia game wey Naija go play Kenya for Calabar ness wik Saturday.

“Bros, make I no lie you, I no dey happy at all as NFF pipu don forget me sharp sharp just becos say I don nack injury.

“No be so life be now, and dis na de rison why some playas no dey tap beta ball for Naija wen dem dey play becos up till now, NFF pipu and even my coachi (Keshi) neva call me to ask about how my body dey.

“Naso dem do Victor Anichebe too wen de guy nack injury wen him bin dey play for Naija lass year and nobody even care at all about him life and you think say dat kind playa go come back and tap beta ball for Naija?

“Senior man, no be everything be money now, but at least make dem call me or visit me so dat I go know say dem love me,” Naso Emenike take yarn.

De guyman wey na him be de Baba for gol for de 2013 Nations cup for South Africa with 4 gols kon later troway salute for him club for Yankee (Spartak Moscow).

“I hail my club as na dem dey take care of me despite de fact dat no be dem I dey play for wen I nack de injury and I no fit wait again to dey kampe and pump gols for dem,” Emenile tok finish. Supersports Pidgin

 

Related Topics

  Subject / Started by Replies Last post
0 Replies
2449 Views
Last post December 26, 2012, 02:15:43 AM
by flukky01
0 Replies
2276 Views
Last post February 11, 2013, 10:30:33 PM
by abayomi
0 Replies
1868 Views
Last post February 12, 2013, 10:05:48 AM
by olaniyi
0 Replies
2162 Views
Last post April 05, 2013, 02:22:23 PM
by flukky01
0 Replies
2002 Views
Last post April 29, 2013, 04:09:38 PM
by olaniyi
0 Replies
1772 Views
Last post November 25, 2013, 07:35:29 PM
by flukky01
0 Replies
2432 Views
Last post August 13, 2014, 08:46:03 AM
by flukky01
0 Replies
1399 Views
Last post October 21, 2014, 08:59:47 AM
by flukky01
0 Replies
932 Views
Last post August 07, 2018, 07:07:22 PM
by PulseNG
0 Replies
155 Views
Last post March 28, 2023, 01:06:31 AM
by thisday